logo
#

Latest news with #Dr Pert Recovery House

Ogbonge South Africa celebrity surgeon Dr Pert don die
Ogbonge South Africa celebrity surgeon Dr Pert don die

BBC News

time31-07-2025

  • Health
  • BBC News

Ogbonge South Africa celebrity surgeon Dr Pert don die

Dr Pertunia Mathibe, wey dey popularly known as Dr Pert for South Africa don die. Dr Pert na ogbonge body surgeon for South Africa wey dey well known for her specialisation for bodi mata. She be di founder of di Centre for Body Sculpting for Pretoria, South Africa. Dem announce her death through one statement for her organisation Instagram page wia dem describe am as 'untimely'. "Na wit great sadness to announce di untimely passing of Dr Pert. We dey heartbroken by dis loss." Her organisation and family describe her as light wey her legacy go live on. "She be light to many, and her legacy go live on through di countless lives wey she don touch." Sake of her death, her organisation don cancel all di appointments wey dem get today. Dr Pert get strong social influence wia she dey tok about body procedures like flat tummy, BBL and any oda body surgeries. Dem describe Dr Pert as more dan just a medical doctor, but she don make name for hersef for di world of aesthetic medicine, and one of South Africa leading body sculpting specialists. According to her organisation, Dr Pert don do ova 100 successful procedures wey she perform on African bodies. She be di Founder of Dr Pert Centre For Body Sculpting and Dr Pert Recovery House. Bifor her death, Dr Pert bin dey passionate about celebrating African beauty through science, artistry, and care. She dey help women do dia body and put am for shape and dose wey wan get curves and beta skin, she dey involved. For South Africa, Dr Pert dey known for her Brazilian Butt Lift (BBL) procedures wey different medical groups don criticise sake of di mortality rates. Dem dey use BBLs to make pesin bum-bum to dey bigger, to round well-well or to lift am up too. Surgeons dey insert silicone-filled implants/or inject fat wey dem collect from oda parts of di body like belly and back to put for di bum-bum to make am big. Dem born Dr Pert for Hammanskraal, Tshwane and she launch her aesthetic practice for 2017 bifor e grow into wetin pipo including celebrities dey patronise.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store